10 September, 2013

Eto'o no do again for Lions



 













Chelsea strika Samuel Eto'o don yarn say hin no go play for hin kontri Cameroun again becos of "family reasin" after kasala tear bitwin am and coachi Volker Finke on top who and who go play, even as hin helep hin kontri reach de final round for Africa qualifia for de World Cup wey dem go play for Brazil.


De 32 years playa, bin don dey tear head tey tey say hin go retire from international futobol even for September 2012 bifor hin come do about turn, bin yarn hin team mates for dressing room afta dem beat Libya 1-0 , say hin don tire and time don reach make hin end de 16 years wey hin dey play for Cameroun, France newspaper L'Equipe yarn.

De anounsement sef bin hapin as Eto'o jam head wit Finke afta de coachi no gree play Carlos Kameni and Achille Webo wey Eto'o bin tell am to play.
Eto'o wey don win de Africa Footballer of de Year four times, bin relate say hin no go fit play becos of groin injuri wey hin get, but hin play de match kuku wear de kaptin arm band sef bifor dem comot am for secon haf.
Cameroun go now play home and away for October and November to take who go qualify go play World Cup for Brazil.
Eto'o wey jus sign for Chelsea las mont from Russia team Anzhi Makhachkala, don score 56 gols for Cameroun inside de 114 time wey hin play for dem, and hin play for World Cup for 1998, 2002 and 2010.

No comments:

Post a Comment